How to Claim Your Apple Music Artist Profile Like a Pro
Omo! If you dey drop bangers back-to-back and you never claim your Apple Music Artist Profile, you dey play o!
Imagine say you be Wizkid, Burna Boy, or even Portable, and person go search your name for Apple Music but your profile dey look dry no bio, no fine picture, nothing wey make you stand out. E no pure, abeg.
No worry, I go run you through how to claim your Apple Music profile sharp-sharp. No long talk, no stress.
Why You Gats Claim Your Apple Music Artist Profile?
Before I yarn you the steps, make I first burst your brain with why this matter dey important:
Control Your Profile: You fit put your fine picture, write a bio wey go pepper your haters, and make your page look professional.
Track Your Streams: Know where your fans dey come from Lagos, Abuja, London, even Yankee!
Boost Your Music Game: Promote your new releases like a boss.
If you wan blow and chop music money well, claiming your Apple Music profile na the way.
How to Claim Your Apple Music Profile (Step-by-Step for Artistes)
Step 1: Enter Apple Music for Artists Website
Oya, grab your phone or laptop.
Go to Apple Music for Artists inside your browser.
Click on “Sign Up”
If you no get Apple ID, create one sharp-sharp. If you already get am, just sign in.
Pro Tip: Use the email wey you dey use for your music hustle. E go make verification faster.
Step 2: Request for Your Artist Profile
After you don sign in:
Click “Request Artist Access.”
Now, you need to find your artist page.
How You Go Take Find Your Artist Page?
1. Open Apple Music or iTunes Store.
2. Search your artist name or the name of one of your albums.
3. When you see your album or profile, click the More (•••) button.
4. Select Share > Copy Link.
5. Go back to Apple Music for Artists and paste the link inside the search box.
Example:
Let’s say your name na "DJ Fireboy", search “DJ Fireboy” or one of your albums like “Ginger Vibes Vol. 1”, copy the link, and paste am.
Step 3: Confirm Say Na Your Profile
Apple no dey do guesswork o. You gats confirm say na your own profile you dey claim:
Select one of your albums from the list.
Make sure say you be the primary artist for the album. (If you na featured artist, you no fit claim am o!)
Step 4: Choose Your Role
You go see options like:
Artist (if na you dey sing)
Manager (if you dey handle artist matter)
Label Rep (if na you dey rep record label)
Select your correct role and fill in the information wey dem ask for.
Step 5: Prove Say Na You Be the Owner
This na the verification part. You gats show Apple say you no dey claim another person profile.
How You Fit Prove?
Connect Your Social Media: Link your Instagram, Twitter, or Facebook. If you get verified badge, na plus!
Screenshot Your Distributor Account: If you dey use Da Blessing Production, DistroKid, CD Baby, or others, screenshot your dashboard wey show your name and song details.
The more info you provide, the faster dem go approve you.
Step 6: Submit and Wait for Approval
After everything, double-check your info. If e clear:
Click Submit.
Your application status go show as “Pending” inside Apple Music for Artists.
Apple go send you email updates about your application. (No forget to check your spam folder o!)
Approval fit take 3–7 days, so just chill. No dey refresh like say na JAMB result you dey check.
Step 7: Manage Your Profile Like a Boss
Once Apple approve you:
Go your dashboard.
Update your profile picture, bio, and all your details.
You fit also approve requests if your manager, label, or team members wan get access.
If you be Admin, na you get the power to control who dey access your page. (Na you be the oga at the top!)
Troubleshooting Wahala (In Case Gbege Show Face)
1. Can’t Find Your Artist Page?
Make sure your music don dey live on Apple Music.
Check say your spelling correct. Apple no dey guess like NEPA.
2. Application Still Pending?
Maybe your verification info no complete.
Try connect more social media accounts or upload clearer screenshots.
3. Claim Denied?
No panic. Just review the info wey you submit, correct any mistake, and reapply.
Why You No Fit Dull This Move?
Claiming your Apple Music Artist Profile na serious matter. Imagine say Rema no claim him profile—e go look anyhow, abi? You gats own your brand, control your image, and track your growth.
No let your music hustle dey look anyhow. Claim your profile today, update am well, and let the world know say you dey here to stay.
Like, Comment and share to that Music artist make need am
#AppleMusicForArtists #NaijaMusicHustle #ClaimYourProfile #NoDeyPlay

Comments
Post a Comment